Home / GENERAL / Sharia court sentence 70 year old Mati Audu to death for rape in Kano
Sharia court sentence 70 year old Mati Audu to death for rape in Kano

Sharia court sentence 70 year old Mati Audu to death for rape in Kano

One Sharia court for Kano for northwest of Nigeria don sentence 70 year old man to death.

Strange Fruit 2020: Black bodies found hanging from trees | New ...

 

Dem find am guilty say im rape one 10 year old girl.

Di judge, Justice Ibrahim Sarki Yola, say di man, Mati Audu, go die by stoning.

Di man na native of Tsanyawa Local Goment Area of Kano State.

Mati Audu confam to court say he be di perpetrator, and court adjourn di case four times becos di judge allow amto change im position, but each time im go back to court im go insist say na im dey at fault. But im want forgiveness.

Judge Ibrahim Sarki Yola then read parts of di Holy Qur’an and oda Hadiths wey show di seriousness of im crime, and sentenced am to death by stoning, citing section 127 (b) of Nigeria Penal Code.

Last month, di Kano state police charge one man wey dem accuse of raping 40 women, including an 80-year-old man, for Kano.

About Chinedu Eze

Check Also

Illustration

A New Beginning

  By Chinedu Eze   Part 1   It was not the first time Steve ...

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *